I no know why some men no fit tie their third leg to their trouser.
Another tory don burst comot say one popular actor, director and
producer for Nollywood don give him housemaid belle. This actor wey I
dey talk about dey fair in complexion and he come from familt wey hold
ground and dey popular for nollywood. No be the first sex gobe wey go
shele for that family be this and people dey wonder wetin dey do the
family.
The actor sef don get 3 children from 3 different women and his
marriage to one popular woman don enter gutter some years ago. If you
sharp, you for don know who I dey talk.
Also the actor na one fine boy like dat and he look like one former
governor in Nigeria. This actor don nak him calabar housemaid akpako
so tey the girl don carry belle.
I no mention name ooo but u go know wetin I dey talk!!!
No comments:
Post a Comment