Gists don carry am say Police don carry one 22years student of Caleb
University, Ugochukwu Agudosi to Ikeja High Court sake of say he rape
one lady in uncompleted building for Ikeja. Dem talk say the boy
always follow the girls wey him dey rape chat for blackberry and he go
come invite them out. The girls go dull themself as Ugochukwu get fine
car. But instead make he carry dem go chop, he go carry dem go one
uncompleted building for Ikeja where he rape them.Police talk say
after he don finish, e go delete d girl from him BB and run away. God
catch am wen one of the girls who be him senoir for school report am
to police. Dem say na the girl carry Police go arrest am for him
house. Anyway, Court don grant am bail sha...
No comments:
Post a Comment