Friday, 27 September 2013

Passengers of Arik Air Block Abuja Airport Runway

Passengers wey dey vex block the runway of Nnamdi Azikwe International
Airport yesterday, september 26.This na sake of say Arik Air flight
wey dem enter from Abuja to Calabar no drop them for Calabar becos of
pOor weather wey make the pilot carry dem go Abuja back. The
passengers con decide say dem no go allow another plane comot for
airport so dem block the runway.But the talk-talk oga for Arik Air
talk say na becos of weather and one VIP no allow dem land for
Calabar. He even vex say the secuirity people no do their work as dem
suppose pursue the passengers comot patapata.

No comments: