Saturday, 14 September 2013

Baba Tinubu Dey Suffer From Parkinson Disease

The tory people of Senator Bola Tinubu tell us say the Baba Tinubu
travel go do knee surgery but one Aproko Magazine wey the name na
Paparazzi Magazine don carry tory say Baba Tinubu dey suffer from
Parkinson disease. The magazine talk say Jagaban no come public again
because the sickness don dey too show for him body as e no fit sign
cheque and and eat well well again.this na becos say the sickness dey
make him hand shake everytime.
Parkinson disease na disease wey no dey allow the body to move well
well. Dem say the signs na shaking body parts and dem talk say na
peole wey don reach 50-60yrs the thing dey catch pass. We hear say dem
oyinbo people still dey do research as the thing neva get cure. May
God heal Jagaban oooo

No comments: