Saturday, 21 September 2013

Blackface Don Hammer!!! Sign 52million naira Deal

Tuface go fit rest now Since Blackface don hammer,Blackface don sign
contract with Franchise Events Limited. The deal also come with new
house and car for the former Plantashun Boiz singer. Blackface don dey
struggle for popularity since the group don break up and the guy don
dey fight with Tuface sake of say Tuface no dey pay for "African
Quenn" wey hin talk say him write. Becos of this one sef, Blackface no
go Tuface wedding for Dubai.
Anyways, Fortune Events Limited loudspeaker man don talk say dem
choose Blackface sake of hin versatility, staying power in the music
industry and his brand
of music.Congratulobia to Blackface!!!

No comments: