Friday, 20 September 2013

Governor Suswam of Benue State Do Bestman For Cook

Governor Gabriel Suswam do best man for one cook named Peter Anyiman
for hin wedding wey dem do this weekend for Our Lady Perpetual Help
Cathedral, in Makurdi, Benue State.
Governor Suswam tell people for the wedding say him dey do best man
for the cook sake say the cook don serve Catholic Priest, Rev. Father
Michael Tumba
in Abuja for over 18 years. Anyiman also talk say him dey honoured and
happy becos the governor of him own state dey do him bestman. He say
no wedding gift fit pass this thing wey Governor Suswam do.

No comments: