Friday, 20 September 2013

Kasala Don Burst as Pastor Dey Patronise Prostitute-church Member

One pastor for Kenya don enter gobe as the prostitute wey hin dey try carrry  be member of his church. the 56 years pastor weey dem don catch before with wife of one of  hin members neva change as hin pick the prostitute for midnight and after the pastor don nack akpako finish, the prostitute con reveal her identity. The lady talk say the pastor pick am up on Friday night along Club Road in the Nakuru area of Kenya “For s*x. I mean that’s why he picked me. That’s what I do, I’m a prostitute,” After she reveal hersef, fear catch the pastor  so tey he beg am not to tell anybody.. the pastor even pay Sh20,000 instead of the normal Sh500. somehow, the secret come out and e don dey cause serious gobe for the church.

No comments: