Friday, 13 September 2013

Final Year Student Don Excretes 25 wrap of Cocaine For Enugu

One 32years student of Nnamdi Azikwe University don shit 25 wrap of
cocaine after NDLEA nab for the new Enugu International Airport. Dem
catch the suspect wey im name be Chizoba Anselem Nwabuwa wen dem do
screening for passengers of Ethiopian Airlines wey dey come from
Brazil. Oga patapata for NDLEA confirm the arrest and e talk say na
liquid cocaine Nwabuwa shit but dem notice am because dem sabi work
well well. Nwabuwa wey be final year student of Fine Arts talk say e
wam use the #500000 wey dem go give am build im Art Gallery since dem
don promise am say Secuirity no go fit know liquid cocaine.

No comments: