Friday, 13 September 2013

PHOTO as Police No Allow Governor Rotimi Amaechi Enter State House

Another Kasala don burst for Rivers State oooo...four truck of
policeman na im no allow the Governor, Rotimi Amaechi and him people
to enter the State House. Some senoir Policemen also dey among the
ones wey go block road and them talk na order from above dem dey
follow. After 30minutes of hot arguments, even the Governor come down
to argue. Last last, the Gorvenor and im people go take back gate
enter ni oooo.
Wetin our eye no go see for this Naija!!!

No comments: