Tuesday, 17 September 2013

Miley Cyrus and Liam Hemsworth Don Scatter Engagament

Shey una dey surprised?? The rumour wey aproko people dey carry say
actor, Liam Hemsworth dey plan to leave Miley Cyrus na true ooo as
their agent don confirm am to E! News. Liam Hemsworth agent dem talk
say Liam believe say Miley bad behaviour nowadays fit affect am inside
Hollywood.
Miley(20) and Liam(23) don dey engage since May last year and dem don
live together sef but aproko carry am say Liam go soon pack comot.
Miley sef don unfollow am from Twitter and we catch am dey dance with
actress, Eiza Gonzalez for Las Vegas after Mayweather fight( the 2nd
photo).

No comments: