Monday, 23 September 2013

Photo of 8month Pregnant Woman Wey Dey Carry Weight

Wahala don shele for internet as different people dey comment on the
photo of one woman wey dey 9month pregnant and she dey carry weight.
The woman na 35years and her name na Lea-Ann Ellison. Instead make she
dey prepare for her delivery day, she dey carry weight and plenty
people don yab am on top the woman. When dem ask the woman why she do
like this, the woman talk say na her hobby be weight lifting and she
no fit stop because of belle wey she carry. She talk say pregnancy no
be disease and nothing go do the baby wey dey her belle. The woman wey
don even born two pikin before.post the picture on facebook.

No comments: