Thursday, 12 September 2013

BabyMama Wahala for Dayo D1 Adeneye

E be like say breeze don blow and fowl yansh don open o for Dayo D1
Adeneye of Kennis Music as one woman named Susan don come out to say
she born pikin for Dayo D1 after he don marry.According to the tori
wey the woman nak,she meet D1 for the Nottingham Carnival in London
and dem don dey nak themselves akpako in secret since then.. Susan
come talk sayshe get belle and born baby girl wey she name Rebecca and
D1 no wan accept the baby as im pikin..Susan claim say she don dey beg
D1 for 2years and since he no wan answer, she don come tell the public
now.. If this tory na true, this na big wahala for Dayo D1 ooooo..
I go dey tell una story as e dey hot *winks*

No comments: