Prof. Ruquayatu Rufai wey dey among the 9 Ministers wey Oga Jonah sack
don talk say she dey go back to University to continue her teaching
job.. The Madam wey be minister of education before dem sack am na
before before lecturer for Bayero University in Kano.she also tell
reporters dem say she pray say make the new minister work on the
foundation wey she don make..
My country-people, abeg shey e no funny to you as per say Na she dey
follow ASUU talk on behalf of Oga Jonah before and now,as dem don sack
am, she gats go back go join ASUU to attack Oga Jonah.. Na true say na
funny world we dey oooo

No comments:
Post a Comment