Thursday, 12 September 2013

Presido Jonah Don Honour Bessing Okagbare

Blessing Okagbare don hammer ooooo!!!
Our own Presido Jonathan don decide to dash 3million naira give
Blessing and 3.5million for her Coach sake of say dem make Nigeria
proud for the 2013 World Athletic Championship weydem do for Moscow in
Russia..Blessing win bronze for 200m race and silver for long jump.
Oga Jonah also talk say im go fit consider Blessing for Naija national award..
wait ooo, I no know na only my eye see am but Oga Jonah short oo abi u
know see as e be like midget beside Blessing??

No comments: