Friday, 20 September 2013

YEPAAA!!! Kpomo Sellers Dey Inject Embalming Chemical for Kpomo

This one na for those of una wey like kpomo like mad.
The Health Officers for Sapele don grab kpomo sellerd for Sapele market
wey confam say na true say dem dey inject chemical wey dem dey use to
embalm for inside kpomo so e go swell well well. Dem talk say dem go
inject the embalming chemical inside the kpomo and dem go come soak am
so the kpomo go look fresh and big.
Dem don carry the kpomo sellers give police sha. Nawa ooo, notin wey
dem never give person chop for Naija

No comments: